Canada goment latest immigration policies fit mean say more pipo wey japa go di kontri go need to return to dia kontri afta dia student visa expire.
Di kontri dey end di Student Direct Stream (SDS) policy, stop to handle asylum claim, plus oda policy wey allow pipo wit student visa to automatically turn to permanent residents.
Di kontri minister of immigration, Marc Miller, tok dis one for one interview on Tuesday, wia im tok about immigration polices plus address some of di important mata wey dey worry international students for di kontri.
Miller say, from di very beginning, e no get any guarantee say students wey come study for di kontri go get permanent residency.
“Wen pipo come here and decide say dem wan be students, e bin no be guarantee to become permanent resident,” im tok.
More and more international students wey dey study for different parts of Canada dey do protest, dey demand for automatic passage to permanent residency or permit extension.
But Oga Miller say big difference dey between study permit and residence permit.
E add say, even though international students get right to protest as par dem dey for democratic kontri, Canada immigration policies priority na to maintain order and balance di system.
For 2018, di goment bin launch di Student Direct Stream (SDS), one study permit processing program wey dem design to process applications within 20 days for eligible students from 14 kontris.
But now dem don do programme for students from Antigua and Barbuda, Brazil, China, Colombia, Costa Rica, India, Morocco, Pakistan, Peru, Philippines, Senegal, St. Vincent and the Grenadines, Trinidad and Tobago, and Vietnam, sake of political tension.
Miller say di goment wan make sure say di visa wey e dey give also dey according to di kontri safety and diplomatic priorities.
Work permit extension
Di postgraduate work permits (PGWPs) wey many International students dey hold don dey near to expire, and so dem dey press di goment for extensions.
Minister Miller say goment no go give dis group of students automatic extensions.
“Some students go gatz make difficult decision as to weda dem go leave or not,” Miller tok, as im explain say e dey necessary for goment to match work permits wit wetin di Canada labour market need.
E also say goment don take measures to reduce di number of temporary residents, including international students, so dem go fit manage di flows more effectively.
But no be only temporary residents dem go reduce as Oga Miller add say: “We gatz to reduce permanent residency by over 20%.”
Dis na afta one latest reduction of permanent residency quota wey dem bin just do.
Canada dey review im immigration laws to fit im long-term needs, wey include di kontri older population and labour shortages without putting pressure on housing and public services.
Canada population don dey old, and Miller say dat na why e dey necessary for dem to kontinu to bring in young workers wey go fit to sustain dia tax system and support im healthcare.
Diafore, im say “to end immigration for three years no make sense economically.”
Dat nay why di goment dey decide to reduce immigration level small, to 20%. According to im, dis way new immigrants fit integrate effectively into di workforce while supporting economic stability.
Managing Asylum Claims
Canada dey get more and more request for for asylum claims, especially from students.
Di minister say im dey worry say some international students dey misuse asylum claims as dia last attempt to remain for di kontri.
Miller say dis many of di claims no pure as im emphasize say e dey important for Canada to maintain di integrity of im refugee system.
Collabo between federal, provincial, and educational institutions dey necessary for di kontri to fit manage di immigration system, so e go fit meet labour market demands plus di socio-economic needs of local communities.
Miller say different provinces get unique needs, and im target na to create ssystem wey go fit to address dia specific needs without compromising di overall immigration framework.
How dis many different immigration policies wey dey come up steady, wan affect international student, and how Canada wan take achieve im long term plan of attracting and retaining global talent.